Categories
Naija Pidgin

Yes, yu fit use big-big words for Naija Pidgin

I no sabi wer dis idea come from, sey yu gat dumb down yor vocabulary wen yu dey speak or write Naija Pidgin. My guess be sey na becos most people dey use Naija Pidgin only as vernacular. Di amount of vocabulary wey yu need for everyday conversations no plenty like dat, and di grammatical constructions déy basic. So wetin most Naija Pidgin speakers déy used to déy limited. Na wetin fit explain wai some people dey prefer to replace English-origin words with lengthy descriptions, or with synonyms wey fit dilute di intended meaning.

For example, person fit talk or write “Na Ofure wey people choose sey mek she be di person wey go rule dem for Lagos state“ instead of “Na Ofure dem elect as governor of Lagos state”. Or dem fit talk or write “US global power don end o” instead of “US global hegemony don end o”.

People wey dey talk or write like dis no understand wetin I want explain give yu now-now. Na di fact sey English na Naija Pidgin superstrate language. Wetin e mean be sey, for di most part, yu fit use any English-orgin word for Naija Pidgin. So no fear! Use all di big-big words wey yu don learn for English take express yorself for Naija Pidgin.

If yu reason am small, yu go realize sey every language get words wey e borrow from anoda language. For instance, 30% of English words bin originate from French. Of course, no be apples-to-apples comparison becos di relationship between English and Naija Pidgin different from di relationship between English and French. Di point wey I dey make though be sey na normal thing for one language to borrow from anoda language. So feel free to use all di big-big words wey yu want use. Di most important thing be sey, mek yor sentences déy grammatically correct, and mek di people wey yu dey talk to understand wetin yu dey talk.