Categories
Naija My Country

Wetin dey worry us for Naija sef?

If yu ask di average Naija citizen wai dis country no dey work for dem, most likely dem go talk sey na awa leaders. Awa leaders corrupt. Dem déy selfish. Dem no get any vision for di country. Na only money dem want chop. Some Nigerians fit even talk sey na foreign influence. Neocolonialism. Di western powers neva give us awa independence. Dem still dey control awa political class. Dem no want mek we progress becos e go threaten dia power and control over us and awa resources.

One thing wey yu no go ever see wen yu discuss dis topic with many Nigerians na agency. Na always oda people get di blame. Na di politicians. Na oyibo people. Na di devil himself. If yu no get agency, yu no go fit déy empowered to change anything. Na wai we dey stagnate. And na wai we go continue to dey stagnate until we realize sey nobody go save us. Awa leaders no go save us. Oyibo man no go save us. God no go save us. Na only us go save awaself!

If yu reason am small, yu go realize sey no be China awa leaders from come. Na for Naija dem born dem. Na for Naija dem grow up. Na for Naija dem learn all di bad and evil things wey dem dey do today. Na we create dem.

If yu reason am small, yu go realize sey foreign influence na part and parcel of international politics. If one country get wetin anoda country want, dem go try influence di oda country. Nobody déy immune to foreign influence. Every country want influence oda countries mek dose countries behave for way wey go benefit dem. So foreign influence na useless excuse. Yu suppose take am into account as country sey, oda countries go try influence yu.

I bin attend two secondary schools. I komot di first one after my Junior WAEC becos my teacher bin force me to cheat. I bin no mind sey some my classmates bin want cheat for di exam. If na wetin dem want do, na dia business. But me, I go study well make sure sey I pass. So I bin déy very angry and disappointed wen my teacher bin force me to share expo for my classmates for exam hall. Wetin surprise me be sey dis cheating thing bin dey come from di oga at di top. Na parents pressure di school mek dem make sure sey dia pikin-dem pass. And den, di principal kon pressure di teachers sey mek dem make sure sey di students pass, apparently by any means necessary. So many students bin cheat becos na di school endorse am. Di school bin dey teach us sey cheating na valid way to run things for dis life. Dis experience no unique to me. Dem bin bully my junior brother for school becos im bin no want join im class cheat for exam.

I sure sey most of di people wey dey read dis article don cheat for exam before. I sure sey many Naija parents go happy to pay money to make sure sey dia pikin go pass WAEC or JAMB. Wen dese children grow up become politician, haw yu think sey dem go dey behave? We don normalize cheating and long leg for dis country. So wai yu surprise sey awa leaders dey do wetin we teach dem? Abi na oyibo man teach dem sey e déy okay to cheat dia fellow country people?

As I talk am before, na only us go save awaself. And e be like sey we neva ready yet.